Perversion... Na d grammar wey she use.I reason am twice..is perversion a mental illness or nature of men?
If man see woman breast for public...especially fresh breast,him eye go come out like headlight..no be so?
If your mind tell you say na so,you're a man!
And nobody go judge you.
If you dey house and your neighbour new wife dey baff outside,you come open window small..check am..come still wait for window for 2 mins when people no dey dere.Who you be?
Wetin no dey your head no go dey your mind.Quote me anywhere.
As d rate wey men come dey rape women and children for Nigeria come dey high,I come dey wonder ..wetin!
Wetin really dey cause am?I sure say no be agbo wey men dey take for streets dey cause am..
I remember dat year he get one school wey dey my area..dem get one primary school teacher wey dey tear people daughter yansh.As I don hear the gist before and the girls parent no dey talk coz of stigma..everybody kukuma quiet...he come get one day around 12 (lunch period)as I dey drive come house,I see one small girl dey go for front and the same teacher dey follow am for back...based on say na estate,everywhere quiet,na only women wey get shops dey d street.My sixth sense come tell me say make I track this people o.Na so I go pack for one corner for front...come use leg waka follow them...like play like play,I reach the guy house,the mumu don lock gate..I peeped through the gate,see the small girl,peep again see the guy dey untie one big dog for back of the house..Na dere na him I know say something dey go on. I come knock d gate.The guy tie the dog back waka come open.
As he open gate,D thunder slap wey I give d guy ehn,d guy 2 front teeth shake.I drag am comot beat am well before the women come hold me dey ask me why?
I come dey speak English..wetin classroom teacher dey carry primary school girl come do for house??
Na so,God free the small girl that day o.This girl never reach 10 years.
D guy na career rapist..and na underage girls he dey rape..so sad!
Wetin pain me that day be say..the women wey dey d street come dey beg make I no beat am or drag the guy to the station..as he never comit d crime na,I just leave am.
Some 30 mins later,I see the proprietor,d head teacher and PTA chairman for my gate..dem enter dey beg make I no report the guy...I com tell dem say I no go report but make dem sack the boy..d boy no suppose dey work where kids dey.
Dem com gree with me ..na so we leave the matter.
Wetin trip me pass be say dem no sack d boy. He still dey work for d school.
He never reach 3 months wey d boy tear another small girl yansh for the area..d blood no be here..before dem catch am d boy don run enter bush..na d last time wey we see the boy for area be that.I come call the proprietor, ask am why he no sack d boy..he come dey look like mumu..d girl mama no gree talk too. I shake my head for these people..
Wetin pain me pass be say,na one of the teachers for the school tell d guy say make he dey run as people don dey come d side.I no be soldier,I no just dey like wetin I hate.Rubbish people!
Most women today dey fear uncle wey dey house but dem don forget the uncles wey dey school.Don't joke with your kids.They are preys in the hands of these monsters we call perverts.
Be interactive with your kids.make dem dey talk wetin happen for school,when dem chop,the kind play wey aunty follow them play..wetin uncle talk for class,wetin uncle dey do
for break period.This is very important.
No be Nollywood ,even though I don say I go shoot short films before Buhari leave power.
Keep your daughters safe.May God help us.
Tunde Travels is a Tourism and hospitality content production and promotional brand that showcases Hotels,Resorts,Lounges,Restaurants, Fashion outfits,Skincare parlors,Festivals, Exhibitions,Trade shows, Concerts, Fashion shows, malls and other places worth visiting by tourists. We partner with brands to showcase their platforms to the world through our blogs,onlineTv, YouTube channel (TundeTravels)and other social media platforms.
Subscribe to:
Post Comments (Atom)
Japa Alert: Companies in the UK Sponsoring Nigerian Talent in 2024
For many Nigerians, "Japa" isn't just a word, it's a movement. The desire to relocate, often to the UK, is fueled by drea...
-
The cold no be here..he get as he dey enter my ear dey comot for nose.If you think say na Moscow I dey..Na lie o..Na one corner for naija na...
-
Wonders shall never end.How I go come explain am? Hmmm...no be small thing o ,my brother! You probably dey wonder wetin do me like dis.......


O boy this matter no be small thing oooo... The guy go eat e o coin very soon. Nice piece bro
ReplyDeleteThanks bro..no be small thing..na wetin my eye see o!
ReplyDeleteWell said. We need to properly look after our kids. Perverts, pedophiles are lurking everywhere(religious and educational institutions, hospitals, homes, neighbourhoods...). It's crazy. They are usually the people you least expect to carry out such despicable acts. It's high time we as a society stop covering up/protecting pedophiles.
ReplyDelete