Tuesday, July 23, 2019

Yahoo plus palava

Wonders shall never end.How I go come explain am?
Hmmm...no be small thing o ,my brother!
You probably dey wonder wetin do me like dis....na one video wey I see on top Facebook still dey burst my brain.
O boy!
Na money be dis!? He get where person go spend money reach wey you go start to dey reason am say where he get am?
As for me,I am not a hater and I have never been a bad fan of merrymaking but for real ehn...some kind money and character dey questionable.
D rate at which everybody dey find money no be here...he get one guy wey dey find woman glory wey him go use get money as d guy don join yahoo plus na...he organized party for one week com invite plenty school girls...make I no mention d name... He slept with about 15 of this girls...d problem now be say,he no see d girls glory use coz d girls no get glory again..dem don use dem finish.I no talk say na AAU girls o!
Dis na open gist for dis town..no be wetin I frame.
As he don reach like 6days wey I post,my eyes don see plenty.Who tell you say I no wan buy benz?
Na one girl story trip me past.Her wahala start from small when he wan do SSCE.As d papa and mama no get money,she come find help go meet one old rich man o...dis baba promise,buy am phone, give her mama money..everything come stew small..as dis girl na virgin dat year..d man try and one day ,d trap catch d small girl and d man deflowered her.Dis same man no give the girl the SSCE money till tomorrow.
Wetin pain me pass be say the girl struggle go school get OND,date other boys etc
He come get this particular guy wey she date..dis guy get money,correct biz wey dey fetch correct money...dem neva reach 6months together before him money finish...as d girl realise say all d men wey she don date dey go broke,she come find help go meet Alfa.. Trust naija girls naaa!
Na d Alfa come tell am say na d old man wey she gave her virginity dey use her glory and all d men wey she sleep with..
Wetin I dey try talk be say,anybody wey sleep with that girl,don enter one chance.
D Alfa come talk say make she bring money make dem help am...she comot d last #200 wey dey her purse ..na her last cash be that.If she no do runs,she no dey chop.Baba don finish am.
I remember one guy wey come from London dat year..dem say na yahoo boy.I laff in Spanish..heheheh jajajaja!
D day I see the man bring alfa ,kill ram com do prayer ontop  d ram for ppl to chop based on party..na him I don run.
 You see why poverty dey dis land? You see why be say your mate wey dey abroad get money pass you?
You see why I no dey go owambe..whether na naming, wedding,burial ceremony or even normal party?
Any party wey I no contribute money package.. Forget it!
Make dem no use me renew money..God forbid bad thing.
Sometimes the problem no be Buhari and his government.
Evil too plenty for dis land n he dey hard for people to excel based on their lifestyles.
Wetin concern me..I kuku dey my own dey look.
Make God bless us with clean money and long life.
Say Amen!

Saturday, July 13, 2019

Fulani herdsmen/Militia: My first encounter.

Herdsmen wahala never tire you?
If you dey support RUGA..something dey worry you...in fact na serious craze you get.Most of the Yorubas wey they advocate for RUGA on social media are either paid to do the job or are just in support of anything that comes out of the mouth of our great mallam.
I don live with Hausas,Fulanis,Kanuris etc I even get Fulani friend that year ..he is educated and ofcourse him be get good background et all.He is brilliant and sociable..sometimes I dey ask myself why dis guy dey always come find me..we shared ideas..political and what not. He dey even invite me to functions where I got to meet some northern bigwigs.Na guy wey you fit consider say he get sense..All of this na because say him na influential black sheep of the family..An average Fulani man no be like that.
The local Fulanis (herders)on the other hand no dey friendly at all..Infact I was advised my a military personnel not to have anything to do with them..dat time sha ,na cattle business dey my head.
Nguru na  town in Yobe..in fact na Nguru railway end for Nigeria and na from there your journey start if you enter Naija from the northern borders and you wan use train carry your goods come Kano.
I remember one day wey I dey road..normally o..if I dey go that side,I dey stop for Kano,enter GRA ,find better hotel,crash till the next morning before I come enter another 3 hour journey go Yobe(Nguru) Enroute Jigawa.Since I never ply the road for night,something come tell me say make I try complete the journey that very day.As the bus wey I enter slow na..I kukuma lean back make I enjoy the journey with kilishi and table water As everybody for the bus tie wrapper for head and nobody dey speak my language.
We don almost comot Jigawa(Adeejah) some few hours to Nguru when we start to dey see buses wey park for road.Fulani militia dey rob for road..o boy! When I check my time ehn..It was around 12 midnight.They robbed for 2 hours o..like play like play. Me wey no understand Fufude ,how I wan take beg this people wey no understand my language or pidgin English make them spare my life?To God be the glory we comot dere and I got to my destination around 2 am in the morning.Dat night, na one corner for park I sleep.
This happened before the boko haram attacks wey una dey hear about...Fulani militia don dey before bokoharam...they are dangerous ppl.
No be my only encounter be dat ,but na my first.
RUGA na good initiative but motive dey and no be wetin FG go carry for head like Dada..the move dey political.
Yesterday, Fulani herdsmen shot and killed the 2nd daughter of  the Chairman of Afenifere, Baba Fasoranti...hope say you remember wetin this Fulani herdsmen use Baba Olu Falae eye see..Some months ago,they kidnapped a woman and her son some 10minutes drive from Baba Fasoranti's house and about 12-15 minutes drive from Baba Falaes..My father is late but his house no too far from these people house..How you expect make I dey feel as I dey so?
Time don reach to strap up..make we dey ready coz anything fit happen anytime..Arm yourself if you have to..Coz the war don dey near..and if you be Yoruba man /boy wey dey advocate for RUGA..continue!
When shit hits the fan,we go find your papa house.
Na we dey here!

Friday, July 12, 2019

Naira Marley and the wailers

I no need remind you who Naira Marley be...You sabi am abi? That's exactly the point.We can't all be famous...no be so? One person talk say famous / great people are like gods or maybe semi gods..for real ehn, it depends on how you wan put am..The question is ..If you get disciples, followers,worshipers(die hard fans),lovers ,haters ,and the power to make things happen ,wetin you be?Maybe I am wrong sha..wetin you think?
Somedays ago, I woke up to a post and email wey talk say make promoters stop to dey promote Naira Marley..these includes club DJs,Radio DJs,Show promoters, Hypemen etc.say the guy dey sing rubbish wey dey spoil children/teenagers life.I laugh in Spanish...hahahhha balamakanchu cha!
Is this shit really happening?
Coming from  guys who grew up listening to the famous Naughty by Nature ,Tupac,Biggie,True live crew (R18) and d rest.Coming from guys wey dey dance 'soapy' for front of mirror for house,coming from the guys wey dey do the 'real soapy ' if light don off..
What do we really want?
OK I get it..Ruggedman fuck up,small boy treat the fuck up..now y'all wanna play that hypocrisy game?
I got lots of respect for OGz..but  4 real , real OGz no dey fuck up..they maintain that balance..if you know you know..
Big artistes plenty wey dey smoke igbo..from the days of Majek Fashek till tomorrow ..they dem self they smoke Igbo and they carry olosho steady..even Some of their mentors/heroes own brothels..Why the sudden hate?
Hypocrisy na major disease for the industry.Don't get me wrong o..I am not trying to compare Naira Marley to the likes of Fela Kuti and the rest..Dem na baba any day.There is a saying in the entertainment world that 'Controversy sells' Abeg o..if the guy should stop ,wetin he wan use chop? Small time this hypocrites go talk say dem get 'Selling point'.
Wetin be Naira Marley selling point?before Naira Marley,yahoo ,smoke,women,wine don dey exist. We never even see anything.. Lol
Guys make una go chill..Una never see anything.
Wetin the Naira Marley Illuminati track mean to you?
My point is people like Naira Marley must exist in the industry if the Industry wan make sense.He is a game changer and you know it.Na big challenge to all artistes,music makers and producers to step up their games.Make promoters no bring personal beef ,selfish interest or one kind monopolistic approach come run d game.Let this boy breathe.
The post sef no be about Naira.My friend talk say who wan drink beer wey no cold?Even for this cold,people go still drink cold beer..Na so!
Let the people be the judge ..let the listeners determine what they want..broda advocate for good music!
Nobody get total control over music.. Not even the government..Who God bless with talent,let no man curse.Let the music play and let the listeners determine what they wanna listen to.Music lives in each and everyone of us.


Thursday, July 11, 2019

As he dey cold so.

The cold no be here..he get as he dey enter my ear dey comot for nose.If you think say na Moscow I dey..Na lie o..Na one corner for naija na him I dey.
Why is it this cold?
I slept late na..how I come quick wake up self?Guy! I still dey my bed o.I have even asked someone to make tea for me,i don attend to two calls and a WhatsApp chat already..2 important calls from the US and a chat with one guy wey I suppose give money after we won the match yesterday. Alcohol is a friendly bastard...he totally forgot everything we discussed but it s OK sha..promise is a debt.If to say we no win yesterday, to drop this money ehn..you go collect visa before you see me.
I can't wait to hear about the juicy match bonuses...I hear say Sanwolu be give Supereagles $5000..na true?
Mikel dash home based eagles all him money?
And d guy dey bench sha...i hope say no be say you dey form?lol
Na joke oo...but bros,retirement age don dey near.
He be like say he go rain this morning..the cloud dey turn black sha..too bad!
I had plans to visit Idanre hills today and take 500 pictures (video slides)for my YouTube channel..Na one guy ginger me o..He uploaded 44 videos ,got 220000 views and made $1400 dollars..can you imagine?
I can teach you how to make money from those pictures piling up on your phone..Yes! I fit help you monetize your YouTube channel but you GATS drop something o...Owo in keke iyin rere!
Na money dey drive this ministry..hope say you understand.
This is my first post for this blog ...I go try package am later..you hear..Please drop your comments below and tell me what you think.
Na we dey here!

Japa Alert: Companies in the UK Sponsoring Nigerian Talent in 2024

 For many Nigerians, "Japa" isn't just a word, it's a movement. The desire to relocate, often to the UK, is fueled by drea...