Tuesday, October 15, 2019

Wetin my eye see Part 1-Idanre hills & Osun Oshogbo pics

I just dey update my WhatsApp status now say he don tey wey I post oo
..if you dey follow me well you go know say na true ..many water don pass under bridge..many things don happen,my guy!

Waka don carry me enter idanre...where I go climb idanre hills (3000ft)..Chioma talk say if I fit climb am she sef go fit climb am..'I shake my head for her inside' come sing 'no go dey do pass yourself'...

If you know how many times I stop for road ehn ..and my load no still pass 2 cameras, 1notepad,Small techno phone,a bottle of water,snacks,mp3player,soul food and paraphernalia... I tell Asprilla when I reach say na me high pass for Ondo state...and he believed me
 3000ft above the sea level  plus extra no be small thing.


My budget for Osun Osogbo festival high small.. Prince Dynast a YouTube Vlogger 'The search for Uhuru' and Pan africanist in d US enter naija...Na only 12 hours I get to shoot ,get footages,take pictures ,lodge for hotel,host d meeting before I go waka d next day...My videos dey one corner..
me and Richard still dey reason based on editing.
I don see Richard job o...Richard is one of Ondo state best editors if not the best sef..Na Hollywood dat guy suppose dey self..

Na when I reach Osun osogbo na him I know why dem change the name of the state from Osun State to State of 'Osun'. See  artworks, Coves,statues etc.
Ppl dey happy worship their gods,see drinking and eating..I come ask my self in English..'Is this how I feel during Christmas?' Even one Igbo woman dey speak Ibo give one of the Yoruba gods (Statue).Her belief system high gan..I for like translate give the orisha statue but wetin be my own...I just come shoot ni.

 Can't you see there is beauty in the art and the act of faith?Na mother nature surround me o...I even stop give monkey banana sef.If person call you 'monkey' my guy!

Fight!!
You can be somebody in future but
Monkey na monkey 24hours a day,365days a year.

Na fun sha..I don post small trailer for YouTube :Tunde Travels ... Trailer no reach..the real one dey come..wahala no dey.
Somebody tell me say make I get Travel buddy..I say no wahala if it meets our terms and conditions lol
How we go take do na?

3 things wey I no go fit do
I can't kee myself
I can't come and kee myself
I can't comango and kee myself

My next post go dey about some business opportunities wey dey online wey I go like share with you, and we go talk about one city for Italy wey dey pay immigrants to settle and do business... Yes oh!
They pay over $10000 to live and do business in a small province in Italy.
Oya na

Saturday, August 31, 2019

High libido or mental illiness

Perversion... Na d grammar wey she use.I reason am twice..is perversion a mental illness or nature of men?
If man see woman breast for public...especially fresh breast,him eye go come out like headlight..no be so?
If your mind tell you say na so,you're a man!
And nobody go judge you.
If you dey house and your neighbour new wife dey baff outside,you come open window small..check am..come still wait for window for 2 mins when people no dey dere.Who you be?
Wetin no dey your head no go dey your mind.Quote me anywhere.
As d rate wey men come dey rape women and children for Nigeria come dey high,I come dey wonder ..wetin!
Wetin really dey cause am?I sure say no be agbo wey men dey take for streets dey cause am..
I remember dat year he get one school wey dey my area..dem get one primary school teacher wey dey tear people daughter  yansh.As I don hear the gist before and the girls parent no dey talk coz of stigma..everybody kukuma quiet...he come get one day around 12 (lunch period)as I dey drive come house,I see  one small girl dey go for front and the same teacher dey follow am for back...based on say na estate,everywhere quiet,na only women wey get shops dey d street.My sixth sense come tell me say make I track this people o.Na so I go pack for one corner for front...come use leg waka follow them...like play like play,I reach the guy house,the mumu don lock gate..I peeped through the gate,see the small girl,peep again see the guy dey untie one big dog for back of the house..Na dere na him I know say something dey go on. I come knock d gate.The guy tie the dog back waka come open.
As he open gate,D thunder slap wey I give d guy ehn,d guy 2 front teeth shake.I drag am comot beat am well before the women come hold me dey ask me why?
I come dey speak English..wetin classroom teacher dey carry primary school girl come do for house??
Na so,God free the small girl that day o.This girl never reach 10 years.
D guy na career rapist..and na underage girls he dey rape..so sad!
Wetin pain me that day be say..the women wey dey d street come dey beg make I no beat am or drag the guy to the station..as he never comit d crime na,I just leave am.
Some 30 mins later,I see the proprietor,d head teacher and PTA chairman for my gate..dem enter dey beg make I no report the guy...I com tell dem say I no go report but make dem sack the boy..d boy no suppose dey work where kids dey.
Dem com gree with me ..na so we leave the matter.
 Wetin trip me pass be say dem no sack d boy. He still dey work for d school.
He never reach 3 months wey d boy tear another small girl yansh for the area..d blood no be here..before dem catch am d boy don run enter bush..na d last time wey we see the boy for area be that.I come call the proprietor, ask am why he no sack d boy..he come dey look like mumu..d girl mama no gree talk too. I shake my head for these people..
Wetin pain me pass be say,na one of the teachers for the school tell d guy say make he dey run as people don dey come d side.I no be soldier,I no just dey like wetin I hate.Rubbish people!
Most women today dey fear uncle wey dey house but dem don forget the uncles wey dey school.Don't joke with your kids.They are preys in the hands of these monsters we call perverts.
Be interactive with your kids.make dem dey talk wetin happen for school,when dem chop,the kind play wey aunty follow them play..wetin uncle talk for class,wetin uncle dey do
for break period.This is very important.
No be Nollywood ,even though I don say  I go shoot short films before Buhari leave power.
Keep your daughters safe.May God help us.

Friday, August 2, 2019

Women sweet

If you dey scratch your body as he dey sweet you,if he no comot water,he go comot blood o.Na him be say if something don dey too sweet you just know say he fit kill you.
Forget craw craw...many things dey happen inside life my brother.I try reason am how life go be if life no get him own sweetness..to jolly na him small pass o but over jolly na him be wahala.
I no wan talk say woman na wetin men like pass o but wetin kill men pass na death wey we be say women involve pass.
I never see one part for bible wey talk say women love your husband but he dey bible say make men love their wives...now if you too love your woman no mean say you go get peace..because say love go make you worry too much and if you come mess up,you fit just pass where you follow come follow waka like that.
I no blame men wey talk say dem wan marry pass one wife.Most of dem dey avoid emotional commitment..as none of the women go wan overdo make the man no go do anyhow.
Woman sweet woman sweet..na wahala you dey find.
One boy wey no dey hear word dat year for Lagos end him life carelessly...with all d women wey dey this life ,na asewo for hotel he like pass so tey,he no dey sleep him papa house,na everyday he dey go mark register.We know wetin end him life-No long talk.
Police find abandoned car for one corner for ikorodu.Inside this car ,na dead body of married man and married woman wey go run package inside car.
One man comot house ,lie give him wife say he dey get early morning meetings with politicians but na woman he dey go fire every morning for another side.When d time reach na him dead body dem carry go hospital.
Ask yourself why Agbara,Babyoku,Pasa and the rest dey move for market,Why senator of the federal republic go buy sex toys for shop,why women dey like move go Lekki and Abuja : For opportunities abi?
Shuuutt up there!
Ask yourself why prostitution remains the oldest trade, why husbands dey go collect house for other women outside marriage,why our president be talk about the other room.
Even women no fit understand the sweetness..d one wey understand self na lesbianism dem dey do.
I no wan too talk story today cos ehn..we are all guilty of these things at some point in life.
Adam chop apple,King David;the man after God's heart kill Uriah, our governors for north dey marry children, Timi and busola dey accuse dem pastor.
Who you come be and how your own take different?
These things dey vex women but dem don forget say d sweetness dey dem body and we men must taste no matter what.Women na women problem.
He don reach level wey be say,people don dey forget say  adultery and formication na sin.Sex,sex,sex everywhere!
 As I dey here so,na moderation be d koko so we go fit enjoy ourselves..
No loud am make d thing no cast!
Na who day break on top na him be thief!

Moderation, moderation...No go dey do pass yourself my brother.Women too sweet!

Tuesday, July 23, 2019

Yahoo plus palava

Wonders shall never end.How I go come explain am?
Hmmm...no be small thing o ,my brother!
You probably dey wonder wetin do me like dis....na one video wey I see on top Facebook still dey burst my brain.
O boy!
Na money be dis!? He get where person go spend money reach wey you go start to dey reason am say where he get am?
As for me,I am not a hater and I have never been a bad fan of merrymaking but for real ehn...some kind money and character dey questionable.
D rate at which everybody dey find money no be here...he get one guy wey dey find woman glory wey him go use get money as d guy don join yahoo plus na...he organized party for one week com invite plenty school girls...make I no mention d name... He slept with about 15 of this girls...d problem now be say,he no see d girls glory use coz d girls no get glory again..dem don use dem finish.I no talk say na AAU girls o!
Dis na open gist for dis town..no be wetin I frame.
As he don reach like 6days wey I post,my eyes don see plenty.Who tell you say I no wan buy benz?
Na one girl story trip me past.Her wahala start from small when he wan do SSCE.As d papa and mama no get money,she come find help go meet one old rich man o...dis baba promise,buy am phone, give her mama money..everything come stew small..as dis girl na virgin dat year..d man try and one day ,d trap catch d small girl and d man deflowered her.Dis same man no give the girl the SSCE money till tomorrow.
Wetin pain me pass be say the girl struggle go school get OND,date other boys etc
He come get this particular guy wey she date..dis guy get money,correct biz wey dey fetch correct money...dem neva reach 6months together before him money finish...as d girl realise say all d men wey she don date dey go broke,she come find help go meet Alfa.. Trust naija girls naaa!
Na d Alfa come tell am say na d old man wey she gave her virginity dey use her glory and all d men wey she sleep with..
Wetin I dey try talk be say,anybody wey sleep with that girl,don enter one chance.
D Alfa come talk say make she bring money make dem help am...she comot d last #200 wey dey her purse ..na her last cash be that.If she no do runs,she no dey chop.Baba don finish am.
I remember one guy wey come from London dat year..dem say na yahoo boy.I laff in Spanish..heheheh jajajaja!
D day I see the man bring alfa ,kill ram com do prayer ontop  d ram for ppl to chop based on party..na him I don run.
 You see why poverty dey dis land? You see why be say your mate wey dey abroad get money pass you?
You see why I no dey go owambe..whether na naming, wedding,burial ceremony or even normal party?
Any party wey I no contribute money package.. Forget it!
Make dem no use me renew money..God forbid bad thing.
Sometimes the problem no be Buhari and his government.
Evil too plenty for dis land n he dey hard for people to excel based on their lifestyles.
Wetin concern me..I kuku dey my own dey look.
Make God bless us with clean money and long life.
Say Amen!

Saturday, July 13, 2019

Fulani herdsmen/Militia: My first encounter.

Herdsmen wahala never tire you?
If you dey support RUGA..something dey worry you...in fact na serious craze you get.Most of the Yorubas wey they advocate for RUGA on social media are either paid to do the job or are just in support of anything that comes out of the mouth of our great mallam.
I don live with Hausas,Fulanis,Kanuris etc I even get Fulani friend that year ..he is educated and ofcourse him be get good background et all.He is brilliant and sociable..sometimes I dey ask myself why dis guy dey always come find me..we shared ideas..political and what not. He dey even invite me to functions where I got to meet some northern bigwigs.Na guy wey you fit consider say he get sense..All of this na because say him na influential black sheep of the family..An average Fulani man no be like that.
The local Fulanis (herders)on the other hand no dey friendly at all..Infact I was advised my a military personnel not to have anything to do with them..dat time sha ,na cattle business dey my head.
Nguru na  town in Yobe..in fact na Nguru railway end for Nigeria and na from there your journey start if you enter Naija from the northern borders and you wan use train carry your goods come Kano.
I remember one day wey I dey road..normally o..if I dey go that side,I dey stop for Kano,enter GRA ,find better hotel,crash till the next morning before I come enter another 3 hour journey go Yobe(Nguru) Enroute Jigawa.Since I never ply the road for night,something come tell me say make I try complete the journey that very day.As the bus wey I enter slow na..I kukuma lean back make I enjoy the journey with kilishi and table water As everybody for the bus tie wrapper for head and nobody dey speak my language.
We don almost comot Jigawa(Adeejah) some few hours to Nguru when we start to dey see buses wey park for road.Fulani militia dey rob for road..o boy! When I check my time ehn..It was around 12 midnight.They robbed for 2 hours o..like play like play. Me wey no understand Fufude ,how I wan take beg this people wey no understand my language or pidgin English make them spare my life?To God be the glory we comot dere and I got to my destination around 2 am in the morning.Dat night, na one corner for park I sleep.
This happened before the boko haram attacks wey una dey hear about...Fulani militia don dey before bokoharam...they are dangerous ppl.
No be my only encounter be dat ,but na my first.
RUGA na good initiative but motive dey and no be wetin FG go carry for head like Dada..the move dey political.
Yesterday, Fulani herdsmen shot and killed the 2nd daughter of  the Chairman of Afenifere, Baba Fasoranti...hope say you remember wetin this Fulani herdsmen use Baba Olu Falae eye see..Some months ago,they kidnapped a woman and her son some 10minutes drive from Baba Fasoranti's house and about 12-15 minutes drive from Baba Falaes..My father is late but his house no too far from these people house..How you expect make I dey feel as I dey so?
Time don reach to strap up..make we dey ready coz anything fit happen anytime..Arm yourself if you have to..Coz the war don dey near..and if you be Yoruba man /boy wey dey advocate for RUGA..continue!
When shit hits the fan,we go find your papa house.
Na we dey here!

Friday, July 12, 2019

Naira Marley and the wailers

I no need remind you who Naira Marley be...You sabi am abi? That's exactly the point.We can't all be famous...no be so? One person talk say famous / great people are like gods or maybe semi gods..for real ehn, it depends on how you wan put am..The question is ..If you get disciples, followers,worshipers(die hard fans),lovers ,haters ,and the power to make things happen ,wetin you be?Maybe I am wrong sha..wetin you think?
Somedays ago, I woke up to a post and email wey talk say make promoters stop to dey promote Naira Marley..these includes club DJs,Radio DJs,Show promoters, Hypemen etc.say the guy dey sing rubbish wey dey spoil children/teenagers life.I laugh in Spanish...hahahhha balamakanchu cha!
Is this shit really happening?
Coming from  guys who grew up listening to the famous Naughty by Nature ,Tupac,Biggie,True live crew (R18) and d rest.Coming from guys wey dey dance 'soapy' for front of mirror for house,coming from the guys wey dey do the 'real soapy ' if light don off..
What do we really want?
OK I get it..Ruggedman fuck up,small boy treat the fuck up..now y'all wanna play that hypocrisy game?
I got lots of respect for OGz..but  4 real , real OGz no dey fuck up..they maintain that balance..if you know you know..
Big artistes plenty wey dey smoke igbo..from the days of Majek Fashek till tomorrow ..they dem self they smoke Igbo and they carry olosho steady..even Some of their mentors/heroes own brothels..Why the sudden hate?
Hypocrisy na major disease for the industry.Don't get me wrong o..I am not trying to compare Naira Marley to the likes of Fela Kuti and the rest..Dem na baba any day.There is a saying in the entertainment world that 'Controversy sells' Abeg o..if the guy should stop ,wetin he wan use chop? Small time this hypocrites go talk say dem get 'Selling point'.
Wetin be Naira Marley selling point?before Naira Marley,yahoo ,smoke,women,wine don dey exist. We never even see anything.. Lol
Guys make una go chill..Una never see anything.
Wetin the Naira Marley Illuminati track mean to you?
My point is people like Naira Marley must exist in the industry if the Industry wan make sense.He is a game changer and you know it.Na big challenge to all artistes,music makers and producers to step up their games.Make promoters no bring personal beef ,selfish interest or one kind monopolistic approach come run d game.Let this boy breathe.
The post sef no be about Naira.My friend talk say who wan drink beer wey no cold?Even for this cold,people go still drink cold beer..Na so!
Let the people be the judge ..let the listeners determine what they want..broda advocate for good music!
Nobody get total control over music.. Not even the government..Who God bless with talent,let no man curse.Let the music play and let the listeners determine what they wanna listen to.Music lives in each and everyone of us.


Thursday, July 11, 2019

As he dey cold so.

The cold no be here..he get as he dey enter my ear dey comot for nose.If you think say na Moscow I dey..Na lie o..Na one corner for naija na him I dey.
Why is it this cold?
I slept late na..how I come quick wake up self?Guy! I still dey my bed o.I have even asked someone to make tea for me,i don attend to two calls and a WhatsApp chat already..2 important calls from the US and a chat with one guy wey I suppose give money after we won the match yesterday. Alcohol is a friendly bastard...he totally forgot everything we discussed but it s OK sha..promise is a debt.If to say we no win yesterday, to drop this money ehn..you go collect visa before you see me.
I can't wait to hear about the juicy match bonuses...I hear say Sanwolu be give Supereagles $5000..na true?
Mikel dash home based eagles all him money?
And d guy dey bench sha...i hope say no be say you dey form?lol
Na joke oo...but bros,retirement age don dey near.
He be like say he go rain this morning..the cloud dey turn black sha..too bad!
I had plans to visit Idanre hills today and take 500 pictures (video slides)for my YouTube channel..Na one guy ginger me o..He uploaded 44 videos ,got 220000 views and made $1400 dollars..can you imagine?
I can teach you how to make money from those pictures piling up on your phone..Yes! I fit help you monetize your YouTube channel but you GATS drop something o...Owo in keke iyin rere!
Na money dey drive this ministry..hope say you understand.
This is my first post for this blog ...I go try package am later..you hear..Please drop your comments below and tell me what you think.
Na we dey here!

Japa Alert: Companies in the UK Sponsoring Nigerian Talent in 2024

 For many Nigerians, "Japa" isn't just a word, it's a movement. The desire to relocate, often to the UK, is fueled by drea...