I no need remind you who Naira Marley be...You sabi am abi? That's exactly the point.We can't all be famous...no be so? One person talk say famous / great people are like gods or maybe semi gods..for real ehn, it depends on how you wan put am..The question is ..If you get disciples, followers,worshipers(die hard fans),lovers ,haters ,and the power to make things happen ,wetin you be?Maybe I am wrong sha..wetin you think?
Somedays ago, I woke up to a post and email wey talk say make promoters stop to dey promote Naira Marley..these includes club DJs,Radio DJs,Show promoters, Hypemen etc.say the guy dey sing rubbish wey dey spoil children/teenagers life.I laugh in Spanish...hahahhha balamakanchu cha!
Is this shit really happening?
Coming from guys who grew up listening to the famous Naughty by Nature ,Tupac,Biggie,True live crew (R18) and d rest.Coming from guys wey dey dance 'soapy' for front of mirror for house,coming from the guys wey dey do the 'real soapy ' if light don off..
What do we really want?
OK I get it..Ruggedman fuck up,small boy treat the fuck up..now y'all wanna play that hypocrisy game?
I got lots of respect for OGz..but 4 real , real OGz no dey fuck up..they maintain that balance..if you know you know..
Big artistes plenty wey dey smoke igbo..from the days of Majek Fashek till tomorrow ..they dem self they smoke Igbo and they carry olosho steady..even Some of their mentors/heroes own brothels..Why the sudden hate?
Hypocrisy na major disease for the industry.Don't get me wrong o..I am not trying to compare Naira Marley to the likes of Fela Kuti and the rest..Dem na baba any day.There is a saying in the entertainment world that 'Controversy sells' Abeg o..if the guy should stop ,wetin he wan use chop? Small time this hypocrites go talk say dem get 'Selling point'.
Wetin be Naira Marley selling point?before Naira Marley,yahoo ,smoke,women,wine don dey exist. We never even see anything.. Lol
Guys make una go chill..Una never see anything.
Wetin the Naira Marley Illuminati track mean to you?
My point is people like Naira Marley must exist in the industry if the Industry wan make sense.He is a game changer and you know it.Na big challenge to all artistes,music makers and producers to step up their games.Make promoters no bring personal beef ,selfish interest or one kind monopolistic approach come run d game.Let this boy breathe.
The post sef no be about Naira.My friend talk say who wan drink beer wey no cold?Even for this cold,people go still drink cold beer..Na so!
Let the people be the judge ..let the listeners determine what they want..broda advocate for good music!
Nobody get total control over music.. Not even the government..Who God bless with talent,let no man curse.Let the music play and let the listeners determine what they wanna listen to.Music lives in each and everyone of us.
Tunde Travels is a Tourism and hospitality content production and promotional brand that showcases Hotels,Resorts,Lounges,Restaurants, Fashion outfits,Skincare parlors,Festivals, Exhibitions,Trade shows, Concerts, Fashion shows, malls and other places worth visiting by tourists. We partner with brands to showcase their platforms to the world through our blogs,onlineTv, YouTube channel (TundeTravels)and other social media platforms.
Subscribe to:
Post Comments (Atom)
Japa Alert: Companies in the UK Sponsoring Nigerian Talent in 2024
For many Nigerians, "Japa" isn't just a word, it's a movement. The desire to relocate, often to the UK, is fueled by drea...
-
The cold no be here..he get as he dey enter my ear dey comot for nose.If you think say na Moscow I dey..Na lie o..Na one corner for naija na...
-
Wonders shall never end.How I go come explain am? Hmmm...no be small thing o ,my brother! You probably dey wonder wetin do me like dis.......
Abeg tell dem o, let dem leave baba alone.
ReplyDeleteOga, what's your definition of good music? See ehn, I think music is subjective to the ear of the listener and the personality that goes
ReplyDeletewith it. Eg., there are some songs /genre of songs that resonate well with me while I simply can't stand some.
For me, Naira Marley's music makes no sense . That's my opinion. Argue with your phone. Period.
Aunty! You only have control over the music you listen to..you don't have that control over mine.My point is let the listeners be the judge .Let the music play. I try argue with my phone but na Naira Marley song dey play.
Delete